Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Dem Catch Pikin Wey Dey Practice To Delete Her Mama

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, August 24, 2022

Pidgin Post - Dem Catch Pikin Wey Dey Practice To Delete Her Mama

Wonders no go end at all....




Nah so i dey listen to one international news station, i come see say dem dey say one 15 years pikin take knife chook two people so dem kuku arrest am..

As dem arrest am finish, dem come dey ask am why she use knife chook the two people, hmmm my people una sabi wetin she answer?

She say she dey practice how to use knife delete her mama!

Dem say more than half of the youth for the Country get kolo issues wey dem dey call mental health for English ....

Ah nah wah.... How pikin go dey learn how to kee em mama? wetin go wrong for this World sef? Things no be like this before oh... Wetin spoil? make we dey use eyes follow wetin we pikin dey do oooo

23 comments:

  1. You for tell us the country na, we no go send our pikin go there

    ReplyDelete
  2. Chineke Mee.... wetin person no go ever hear? Why e come be say na im mama im wan delete? Odiegwu!!!

    ReplyDelete
  3. God no go let us born pikin wey go delete us o and we too no go delete our parents dem. Amen o

    ReplyDelete
  4. When dem begin agree to be no binary abi watin dem call am. And when dem begin dey play God with dem life.

    ReplyDelete
  5. Learning how to kill her mum???? Wonderment.!!!

    ReplyDelete
  6. Na only God go help us...so te pikin dey do practice on how to kill him mama...wen persin see wetin pass am,e good make him take all mata to baba God

    ReplyDelete
  7. Hmmm... May God help us to be godly parents that would raise godly children.

    ReplyDelete
  8. God no go let us give birth to that kind pikin

    ReplyDelete
  9. Naso dis pikin for kee him mama.God abeg o

    ReplyDelete
  10. Learning how to kill her mum...Na wa

    ReplyDelete
  11. The devil na roaring lion true true, he dey look for souls to devour and him don catch plenty, na make God dey protect us from all these evils dem... Amen πŸ™

    ReplyDelete
  12. Make this kind pinkin pass as menses oo in Jesus mighty NameπŸ™πŸ™πŸ™

    ReplyDelete
  13. Bad company. What they watch and I don't care parenting.

    ReplyDelete
  14. E no go pass UK

    ReplyDelete
  15. Do you know if she is in an abusive situation? You Africans always worship parents like all parents are saints.. you will be amazed the hell some kids go through...some people are not meant to be parents.when we don't know the dynamics of her family so not excusing murder though.

    ReplyDelete
  16. Toxic parents
    Toxic children
    Drug use
    Evil friends, cults, demonic possession
    mental problem
    Can trigger

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141