Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Labour Room Magic

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, August 19, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Labour Room Magic

 Haaaaaaa, curses in the labour room?






Kpoi! Kpoi kpoi! Na who dey house e?


Una SDK pipu dem dem. I greet o!


Stellalipoppins...how the horizon?! I hail o!


Na noise we hear inside hospital as I follow person go greet person!


The woman wan come deliver, she begin wail, lament, pray...nothing wey she nor do!
Na only her elderly Mama follow her come there.


The Mama dey try hold her make she nor wunjor herself! As she dey fling hairnet, na so she dey fling slippers!


Nurses say make them leave her, as the shout go help pursue the baby comot! Una say wetin?!


The nurses just dey waka pass like say na nothing!


As we enter go greet our person wey just born, Na she tell us say the woman's husband abandon her for midnight since 8months ago! The baby don almost due now, as she come hospital na so so strong, strong words they comot for her mouth! *Hmmm!*


The one wey my spynoculars carry, na when she call the husband full name say 'na only if no be him be the first and only man wey climb her, make everything begin work against am until he come back'! *Choi!*


Her mama dey close her mouth say make she nor too talk!


Nurse wey dey duty for reception, dey chop bread and butter, carry hot tea inside one gigantic mug, waka pass inside like say nothing dey happun!


I say aunty nurse, una dey try o!


She say na me dey worry! She say the kain lives wey don scatter on top woman 'under', na only God sabi!


She point the woman wey dey wail say, the woman na technical virgin she be, as na just once the husband touch am wey she carry belle and he disappear with another woman!


She say make i dey watch o! Say if the man dey innocent nothing go do am! But if not, she say anything wey the woman talk inside that pain! Heaven sef nor go deny am! *eleeeeeee!*


Hmm...Na so I begin hear shout of another woman. Her husband go buy her Amala come, she shout for him head say na Semo she send am!


The husband don climb stairs like 1million times! Na as he dey buy boiled corn, na so he dey find avocado upandan. Later, I see am from window as he leave car, carry plate dey cross road, begin find wetin nor loss!...if this man nor gree touch him wife again, anor go blame am! He see shege!


When time reach to enter theatre, they carry cap and scrub give am! He say he nor wan enter! God abeg e!


Aneva see man wey fear him wife like that! He ask if she go sleep during delivery?!

Doctor say Mba! no be operation, so na she go push!
The wife say 'baby come closer so I can hold your hands'...I don laff scatter leg for ground! Nna ehn!


Anyways na twins she born, no wonder na double stress she give her husband!


Back to the woman wey dey very sad! She come talk another one say if God truly be God, make the husband leave wherever he dey, come back house before the baby come out!


The Mama say No o! If the man no gree come another year nko! Say make she nor dey talk like that! Choi, anor know as water jor comot for my eye!


She just dey call him full name plus him mama name say anything wey that strange woman use tie am must scatter Because she nor thief person joy!
I begin cover myself too with prayer because anor know the kain Angel wey dey pass with vex!


They carry her enter go check, they ask if her mother wan enter with her? As na her only relative she sef insist say, yes!


They enter o...they tehhhh...Nna ehn, anor gree go house! I begin stretch neck, begin ask Nurse say how far! Nurse say pikin nor gree come and she just dey shout her husband name say wherever e dey! E must come!


Choi...goosebumps full my body! Aunty Nurse don go carry Fanta and chin chin to top up, they sidon begin watch African Magic. I just dey wonder how dey get mind like that!


Another couple come, husband say he wan drop him wife with doctor say she dey Disturb him for house! Make dem give her private room with television. I laugh no be small!!


She go run follow him dey cry like small pikin! He say e go buy pizza and chicken and bring for her! Na that time She leave him hand o! God abeg!


We still dey laugh their drama when one Tall, fine man enter the reception.


He ask for him wife name. Aunty Nurse wey dey chop chin chin, look the man ask him where he dey come for this late night? And wetin dey the box wey he carry?


He say na Abuja he from come. Say him wife send am text since yesterday say she dey hospital to born, but he just see the text that night, Na why he come!


E never reach 1minute wey that man enter that reception wey that woman born o!
One nurse comot from inside there, the chinchin Nurse follow am whisper something.


They carry the man near labour room door. Na where the woman Mama begin talk their dialect dey thank God, dey use wrapper clean eye! The man enter go see the baby and wife!


Hmm!...for the things wey the nurses and women in Labour dey see...to God be the Glory.


I dey go yard for solemn mood jeje, Na im this sekuriti dey block me for gate, he say I be patient wey wan run!
I tell am say if e no comot for my front, prosthetics nor go fit fix the centimeter wah go use measure your face na,na!

36 comments:

  1. Sisi carry labour room gist brekete come we yard today. See correct gistπŸ˜‡

    ReplyDelete
  2. Replies
    1. πŸ˜‚πŸ€£ some men no even get strength for belle cravings.. You will hear 'the baby wants to lick Ice cream, the baby wants to watch big brother! The baby wants to eat yakoyo at 2am! Sora fun obinrin O,olorun a wa pelu E!πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£

      Delete
    2. Haaa! Baby wan tu watch big brother ke?

      Delete
  3. 🀣🀣🀣🀣… This is just too funny..thanks sis

    ReplyDelete
  4. This reminded me of my labour,when the nurse checked my cervix in the morning it was closed,even my v** was super tight and the next question was?
    Nurse:where is your husband?
    Me:He is not around
    Nurse:when was the last time you had sex
    Me:Few months after I got pregnant,he was transferred for work.
    Nurse:My dear,please when real labour starts don't curse him
    Me:I was like curse ke,he went to work for both of us and we still spoke this morning.
    Nurse:I know,when some women are in labour they start cursing,even the ones that have their husbands around are not left out.
    Me:thank you ma!
    When the real thing started,I didn't even remember anyone,I was just praying for the child in my womb,calling Jesus,exhaling,shaking my head with eyes closed and after nine hours I gave birth.
    Labour isn't child's play,May the Lord grant our pregnant ones safe delivery and bless those looking upon him for the fruit of the womb in Jesus name.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Labour nor be beans, my three pregnancies where laced with drama, but God saw me through. I never cursed hubby though

      Delete
  5. "I tell am say if e no comot for my front, prosthetics nor go fit fix the centimeter wah go use measure your face na,na!" Laugh wan kii me, madam you na case.

    ReplyDelete
  6. I enjoyed reading.its brought joy and laughter to me...thanks

    ReplyDelete
  7. Hmmm...Labour room drama no be here at all....

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na wa ooo. see gist berekete.. God we dey here oooo

      Delete
  8. 🀣🀣🀣🀣Awwwnnn

    ReplyDelete
  9. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    thanks for keeping us entertained, I remember the first story you sent in, I laughed so hardπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  10. 🀣🀣🀣🀣😒😒😒

    ReplyDelete
  11. Na wa oh, husband snatchers, are you seeing what you put your fellow women through? Married men wey dey find wetin no loss outside, may you not be baptized with curses, take it or leave it, some curses work!!!

    ReplyDelete
  12. See beta funny gist o🀣

    ReplyDelete
  13. Me Sha thank God I no Sabi create scene for anything go reach labour, kia I bear am till bomboy say he don ready to come out. I enter there e no reach 30 mins I comout.. E no easy but e go must better for every mama out there! Joyfully we go reap the fruit of our labour Amen

    ReplyDelete
  14. Thank God the husband came and the wife finally delivered. Sisi well done πŸ‘

    ReplyDelete
  15. Replies
    1. Indeed God is God. See painful prayer and God honored it, the man appeared and the baby came out. What a wonderful name - Jesus.

      Men be careful o. God answers prayer

      Delete
  16. You na confirmed amebo. Thank you for not keeping us in suspense on that new mum. Imagine getting a virgin pregnant and abandon her. What do some men want?.

    ReplyDelete
  17. I keep asking God for strength on dat day nd fast nd easy Labour. Cos Labour room drama no be here oo

    ReplyDelete
  18. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  19. Let God remember me o. I want to experience labour room drama.

    ReplyDelete
    Replies
    1. You will soonest. God has done it before He will do yours too speedily. Amen

      Delete
    2. May it be as you have wished.

      Delete
  20. My best on ask, never disappoints 🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  21. Sisi you carry better gist wey funny come sense join......Safe delivery for my Wife and all pregnant women, una dey try. God bless you all.

    ReplyDelete
  22. God bless all mother's ooooπŸ™πŸ™

    ReplyDelete
  23. Lord please grante a seamless delivery that I may come back here and testify in Jesus name. Amen

    ReplyDelete
  24. I am glad the husband returned ooo.... I was so glued to his gist enh...

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141