Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - The King Must Marry More Wives To End Shakara For Kingdom

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, September 08, 2022

Pidgin Post - The King Must Marry More Wives To End Shakara For Kingdom

 Una don hear the gist wey dey for town?.. If you never hear am, your amebo Antenna don spoil.






So the King don marry new wife but oh boy eeeh,more wives dey load, as dem marry one wey no go let person hear word, small quarell dem go enter social media go dey make noise, na so the King don decide say e go marry dem plenty...


The king sef too get strong mind, God abeg!

First Marriage scatter, wife wan come back, baba no gree so she kuku waka find her way, aftoroh other men dey, second marriage scatter after wife disgrace am for Internet, she wan settle Baba no gree, she kuku waka, aftoroh other men dey.

The third wan enter Internet say e no wan marry again, do long post speak big grammar, as dem dey talk settlement, we hear say Baba tell am say delete post wey you do, she no gree, come waste time dey do drama on top, before e know wetin dey happen other women don line up for ground to marry husband wey she say she no want again...... Maybe dem go add am to the harem or maybe she sef go waka finally, aftoroh other men dey and we hear say second wife don marry again (No proof yet oh)

Dem say Baba go still marry more queens to balance the equation so make we dey wait see wetin go happen... 

Nah which tribe talk am say wen fest and second wife don do shakara too much,nah more wives dey settle the matter...

Make we dey wait to see how many more wives go follow wife number four but make una check dem to see say Baba no dey find small small gehs again.

Make i go call informant for more update....


**helloooo**

44 comments:

  1. 🤣🤣🤣🤣 he is allowed marry them young. Hiii

    ReplyDelete
  2. This is why we shouldn't envy anyone or make comparisons with other people's life. When the second and third marriages went internet viral, a lot of ladies awwed and wished. The pictures were nice. You really have no idea what goes on behind closed doors. That's not to say we should wish others bad, but in life, each of us has been given a measure of blessing and challenges. Accept yours, don't wish for another's.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Ok but what is the man doing that is making these women quarrel with him all the time. Noone is asking that

      Delete
  3. King Solomon of our time,marry dey go kabieysi .Baba dey marry mature women now small gehs dey give am wahala.

    ReplyDelete
  4. Yes o SDK .na mature woman baba dey find now, no small ghehs wey him mama dey control

    ReplyDelete
  5. I don't know who this post is about but I reject that kind of man. I reject him for my daughters and granddaughters. What a shame!
    Like I said, I don't know who this post is about.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I was saying same o. Seems that part of the world, women are not valued. They are seen more like replaceable chicken. Naija women take note

      Delete
  6. 😂😂😂😂Na here we sidon de watch as every every de hapun. Make Baba continue to de marry as im like, aftoroh na King im be.

    ReplyDelete
  7. Make we hope say this one go stay 'till death do them part'. Abi how many wife baba wan marry before he reach im promise land. 😉

    *Hi*🤗
    😏

    ReplyDelete
  8. Hiiiiiii
    He should marry more to balance the equation afterall he is iku baba yeye,alase ikeji orisa.
    Prophetess will calm down but I pity her sha

    ReplyDelete
  9. These women already know what they are getting into,a king in Africa are entitled to marry many wives no with hazzle,no woman can have monopoly relationship over a king,tradition allows them to marry lots of wives

    ReplyDelete
    Replies
    1. Entitled and covetous men promax

      Delete
    2. Anon 18:50 na where we go see African men be that. Bedroom prowess n accumulation of pum pum. How come European kings don't accumulate wives like that. Make una use religion n tradition cover una indiscipline n immortality

      Delete
  10. Stella ina acho okwuooooh
    Na onni of ife right? Me I'm not sureoooh I'm not good at decoding

    ReplyDelete
  11. Wahala nor too much laidis?

    ReplyDelete
  12. Baba dey go for the mature ones wey go fit endure challenges and remain as wife for him no mata what

    ReplyDelete
  13. Replies
    1. Thought that was obvious. I've already seen that he is marrying an extra wife on other blog

      Delete
  14. hmmmnn.. ok na. here for the comments

    My mind it telling me Oni of Ife

    ReplyDelete
  15. Na their agreement be that,Every one of them get wetin dem dey find inside.

    ReplyDelete
  16. Baba no wan gree oh! I don see the new babe wey him wan marry pics sef,na yellow pawpaw wey dey stay Scotland for abroad..baba wan break King Solomon record

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣 the record must be broken naa. Howdy babes? 😘

      Delete
  17. Hmmmm na this news dey reign for my Facebook timeline.
    They say baba dey welcome two iyawo this month. But my own be say make iyawo dem shine eye oo cause of the cane dey always dey back of door abi shey na broom.

    ReplyDelete
  18. That's beautiful prophetess carry love for mind enter that marriage.

    ReplyDelete
  19. I noticed he now goes for women with cash..guess he is broke🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  20. Ayaff said my own, anything marriage and women mata of this senior chief and Ned, my hands are off. Na look and congrats we go dey dey.

    ReplyDelete
  21. What about the black beautiful lady after prophetess Naomi?

    ReplyDelete
  22. Is Queen Naomi of Ife the 3rd wife?
    I thought she is the second after Queen Wuraola? Or am i missing something?
    I wish Naomi well.
    I wish she just stayed with the King and continue to build strong strength against all these oppositions. She and the Ooni looked so perfect. He was always all over her. But she wears the shoes, and know where it pinches. I wish her well.
    How many will this king now marry? Does he love these women? Do they love him? Or he is just marrying them to fulfill tradition. How does a marriage without love work? Do these people have to pretend and endure forever?
    If he has to marry several women, i think he should go for older women, they have the emotional stability to withstand whatever. Naomi is a young girl. I wish her peace to move on. King Ooni please forgive this young lady(Naomi) and embrace her with love. Naomi you too delete post na, and let peace reign.What is the aim of keeping the post there?
    I wish them all the best.
    Sista Jane

    ReplyDelete
  23. The royal 'amu' is on rampage.Egungun be careful🎵

    ReplyDelete
  24. Anybody wet dey marry This kain baba should not carry love for her heart enter the marriage if not, na blood go dey pour out for eyes when she dey cry .

    I see say the baba new bride no young ( forget the age wey Dem talk online). He tried. The man should not marry young girls again.

    ReplyDelete
  25. Is like Naomi has finally deleted the post and she still bears his surname on ig

    ReplyDelete
  26. During their marriage did the prophetess not pray for him to marry more women? Or am I confused? What then is the issue?

    ReplyDelete
  27. But the 2nd wife was a mature woman nah. The Ooni doesn't seem thrilled by his new 4th wife.

    Wishing all intending wives the best!

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141