Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Missing Okuko.

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, December 30, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Missing Okuko.

Hahahahaha.....


Kpoi! Kpoi! Kpoi! Na who dey we yard e?!

Stella-santa-la-snowflakes! How dey overs?!

Una compliments of dey weather o!

My customer say she nor dey do anything wey go stress her this season.

I say una nor go get visitors? She say na only one brother in law she get. Her own twin sister dey obodo oyinbo.

She say the thing wey her BIL carry her eye see last year! God forbid bad thing!

I balance say make she knack me tori o...
She say she buy two gigantic okuko, bag of rice and other things say at least, Christmas and new year don settle.

She say she go salon come back, One full, mature okuko wey get bearbear don miss! *Hian!*
Chineke! Who wan enter balcony for upstair, get confidence and lift a whole okuko!

She say her twins go their classmate birthday. She never go carry them come back house sef!

Na who she go come ask?? BIL say na inside room he dey all day!
She say so he nor hear okuko wey dey shout like say person wan thief am? He say mba!

Issoraite, na last minute she go buy frozen turkey to balance the thing!
Customer cook jellof rice and turkey, and other small chops wey she order!

She comot go hospital to see her MIL wey dey on admission with Orbii!
*you remember this her MIL wey threaten her say she nor go see next december!*

Na im dey come back house, the second okuko don enter metaverse!
She nor even see feather talk of chicken shoe!

Na im she say she crase! Wey she go face her BIL say if he nor confess, he kukuma know say she be crase! Say she go call the entire community ontop him matter! Kiikiikii...

Nna ehn, nothing happen!

Na boxing day wey person begin bang door at 6am! Na wetin be this?

She say na police show face with one guy, that one say dem bet and BIL nor gree pay!
So he agree installmental, as he no get money, so BIL snap okuko pisure to negotiate! Na so he carry the okuko give am, some days to Christmas!

Ehn ehn so wetin come remain?!
He say he still dey owe am, so he wan come carry the second okuko or money balance!

I say wetin your Orbii talk?!

She say Orbii pay the boy, they comot with police! As he nor dey like make anybody hear their voice for their compound!

Ok na! So where the Second okuko go?! He deny say no be him o!

Na for evening wey Landlady call her say thank you for the okuko o, as her BIL don begin take care of him wife, wey be her daughter!

She say she nor mind if customer send groundnut oyel wey dem go use fry the okuko!
* i don laff throway leg for up o!*
I say you hope you add half bag of rice join the oyel?!

She say she nor only go retrieve okuko, she say landlady sef chop elbow on her way out!

Kiikiikii...!This one off me o!


* So e use one okuko settle bet and use the other one settle em babe...hahahahahahahaha

I dey wetin ''Orbii'' mean.

15 comments:

  1. LMAO..... this kai BiL go fit sell all of una and una no go sabi say he don cememt the deal.na to dey carry am dey go anywhere u wan go so.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Orbii is Hubby as in HorsebandπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£

      Delete
    2. Na to kidnap this BIL and drop him with native doctor wey dey nurse crase people! When they fi lilu ba ti e je! That woranworan will not jump out, Iro o, it will pickrace 440 and die! Sho loun stewpidt ni?!πŸ™„

      Delete
  2. Very crazy BIL,God forbid.@ Stellz,Orbii na hubby.

    ReplyDelete
  3. BIL from hell. Sha make e nor use your twins do exchange one day. Why her orbii no let police teach am small lesson

    ReplyDelete
  4. 🀣🀣🀣🀣Nawah for your BlL

    ReplyDelete
  5. Na which kain BIL come be dis eeh? Sisi, tell ya friend make she dey kiaful with that guy make e nor go cause big wahala for am one day.

    ReplyDelete
  6. 🀣🀣 correspondence Sisi. This kind bill na wa o. He fit use him family play naijabet one day.
    Ok,orbii na hubby 🀣🀣

    ReplyDelete
  7. That her hubby sef no try. He suppose caution him brother naa.

    ReplyDelete
  8. This her brother-in-law must be the shame in shamelessness. How can he steal chicken from his brother's family to give to his girlfriend that lives in the same compound? Like, how?

    ReplyDelete
  9. Wahala dey like custard were them put overheated water de tin com turn mold, mold instead of mud, na to tro away πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141