Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Meat Stealing...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, January 30, 2023

Sisi Senaponi's Corner - Meat Stealing...

Na real wah!

Una doh o! I greet o!

Stellabutterdelacreme...how dey oraizin?! I hail o!

As i dey waka to go open shop for boxing day. Make i see if me sef go see Christmas gift open.

Na im i see this my customer wey go grind pepper inside market.

He follow me buy market, he say he nor dey expect visitor o.
He jor wan dey inside haase, meh he sleep, watch mount zion fim, read bible, chop and enter New year!

I say you nor geh family wey you wan visit?! He say he get, but he nor wan go!

He say na dem first scatter him life before he begin work for him former oga!
Say na car business he dey do before, wey better money dey him hand!

He say even the woman wey he been befriend, engage to marry don leave am go as money nor dey!

I say you sure say na because of only money she comot?

Aftoroh, i know say if woman love man, she nor go mind if na only one dross he get! Oya, talk anada one?!

He say the problem for him business and attack plenty, she get miscarriage after 7months wey she almost die!

Na her family come carry her from hospital, even arrest him sef say he wan use her for ritual as money nor dey again!

He say na one of his old school mate, carry him go meet one prophet.

Everything wey dem say make he buy and do, shingbai nor dey him pocket.

He say his friend say thesame prophet warn him say the spiritual problem wey dey him friend head strong o!

Say make he nor try to borrow or dash him money to do the spiritual works or na him head the problem go land!
He say his woman before tell him for hospital say sometimes he go wake up for night begin sound like goat or even ram.

He say as he wakawaka dey find cheap one room wey he fit rent, since he don sell everything wey he get to chop!
Na for Mama Nedu shop he sidon under hot sun that day.

Wey person wey dey waka pass, preach to am, invite him for their church service.

He say he lie say he go follow the brother, but he nor get intention of going.
He say na so the wife to be call him say, she dream o say he die!

Say her mama don carry her go church, wey dem tell her say e get where dem go chop Goat and Ram meat!

He say na how that brother know him house he nor know, say he come knock him door wey dem go church together!

He say as he wan enter the church like this, na so belle begin worry am! Body begin scratch am!

He say the ushers for door, tell him make he nor turn back o! Say na dehvoo handiwork!

He say as he enter the brother church auditorium like this, the belle come be like say fire dey burn! He say he nor fit waka again!

He say na that day he know say power pass power!

He begin sweat, the brother begin plead blood of Jesus! Members dey pray dey go, minding their business!

Come be like smoke full everywhere for him eye! Like fimtrick, fiam! Everything jor normal again!

He join dem for the prayer begin sweat inside serious AC! *choi!*

He say that night, he sleep like pikin!

The first call wey he receive na about him former oga where he dey work, before he start business.

He say him Oga nice well well. Even add money for him to start his own business that time.

But na every New year,,this oga dey do party and invite everybody.

As he get money reach, he nor dey buy cow o, na either goat or ram the oga dey kill.
He nor know say na that meat the oga dey use to put them inside bondage, if dey wan prosper pass the limit of the oga, the thing go press im head down again!

He say nor be say instant poverty o. Mba, he say na slow and steady! No suspicion or traces!

He say after he do mistake enter that church, wey dem give him some prayer points for the church, he say nna ehn, na the following day he hear say him oga fall from seat inside parlour, nobody push am o. Na stroke hit am!

He say he go visit him former oga but the wife say he nor wan see anybody! Say he wan rest!

He say he try see if him wife-to-be family go gree make he at least hustle, make dem marry.
He say the Mama say mba! She say their star nor match! Make he face front!

He say as that church brother don teach am how to pray and scatter darkness with fire, his business don dey come up.

He don dey reason to move next month inside self-con. As na face me i finish you he dey.

He say he nor dey ever for him life go person house to chop any thing even if na naming!
I say na real wa o! Things dey okurrr o! To branch and chop firewood Jellof and Goatmeat now na war!

11 comments:

  1. Na wa o
    May God continue to protect us o.

    ReplyDelete
  2. Replies
    1. As in! Story plenty! Person know say to dey waka chop anyhow na dangerous sometin!!! Mehn make we no learn d hard way abeg

      Delete
    2. God abeg anything wey I eat mistaken or not,may it not affect me negatively o.

      Amen

      Delete
  3. Na wao...all this Oga sef.
    Thank God for the guy life.

    ReplyDelete
  4. This things happened all the time. May God give us a decerning spirit

    ReplyDelete
  5. A lady in my office did birthday and shared a lot of goodies, I just felt an urge in my spirit not to eat anything she shared, I collected and gave it out. I noticed her attitude towards me changed since that day. I'm just laughing in my spirit, me wey be ogbologbo for spiritual battles, she's probably fooled by my youthful look.

    ReplyDelete
  6. A lady in my office did birthday and shared a lot of goodies, I just felt an urge in my spirit not to eat anything she shared, I collected and gave it out. I noticed her attitude towards me changed since that day. I'm just laughing in my spirit, me wey be ogbologbo for spiritual battles, she's probably fooled by my youthful look.

    ReplyDelete
  7. Wetin ppl dey do and the length dem dey go becos of money ehn....

    ReplyDelete
  8. Nawaa o. But sisi, u the like owambe, hope u don learn from the brother.

    ReplyDelete
  9. Things dey occur oh,my husband has taught me to the level wey I go eat from home before attending a party. He just doesn't like eating in a party except he loves the host genuinely although back then he doesn't believe in all this spiritual stuff unlike now.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141