Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - POS DNA

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, February 17, 2023

Sisi Senaponi's Corner - POS DNA

 Wahala be like Bicycle.....





Kpoi! Kpoi! I greet o!

Stellamarblesgelato...how your side?! I hail o!

Wonders!wonders!

Na inside all these whole naira note and fuel palava,wey this POS man comot house early momo.
He go bank, before he run go queue for fuel!
For their compound , na noise and shout make people begin gather!

Wetin happen?!

The POS Man get Wife wey be Aunty Laura. Aunty Laura say, one customer Mummy Junior, sent her son to come and withdraw cash.

The boy said his mother has already transferred 100taasand naira to the POS Man Akant number!

The POS Wife say, her husband nor carry the phone wey dey see alert go bank! She say he leave am for shop dey charge am. And she don check well well, no alert or balance increase!

Hmmm...Na im she make joke say, inside this economy, where Junior mama wan see 100taasand transfer?!

POS wife, tell the boy make he go tell him mama to send the receipt to the POS whatsapp number!

She say, if im mama really do the transfer, she nor go fit give her pass 10taasand cash as money nor too dey grand! And if she go transfer the money back to him Mama, she go comot bank charges and commission!

Nna ehn...

Na only locomotive wey nor get brake fit do person, as this Mama Junior do the POS wife!

Junior go house, relate everything give him Mama.

As weather hot, wey hunger dey finish people, the woman gather frustration and aggression, wear jeans under wrapper, go collide the POS woman!

Na there people come gather to separate fight!

How you want make she pay you when she nor see alert?! Ngwa! Show us from your phone the transfer wey you do!

Na im Mama Junior say even the POS man wey get the business, nor fit come back tell her that nonsense!

The POS Man nor quick come back, his own mother wey get the house come outside put mouth!

The Grandmama say, why the POS wife wan drag their name inside mud?! She say why she nor call the husband and confirm?!

She say husband nor carry phone go!

Na im the Grandmama do like water wey enter hot oyel!

Grandmama tell the wife say, na to carry chest block her pikin money she sabi do! Say no be woman her mate don born 3boys for thesame husband wey she dey use him money rub cream! Choiii!

Na there the Mama Junior bone come strong o!

Mama Junior say, that 100taasand na the money wey POS man, wey be her "Baby daddy" suppose don bring for her since the day before!

So make POS wife enter shop, bring the money comot!

As i turn look back, people don dey waka comot, face their shop!

Matter don conclude na! Abi wetin remain?!
Government don help them save money for future DNA!
The case na son know thy father, and father knoweth thine son!

No need to dey waste money give fake prophet! Breeze blow, fowl nor wear dross, na wrapper he tie for head..

14 comments:

  1. Sisi for president. Tuale oπŸ™ŒπŸΌ

    ReplyDelete
  2. Sisiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiii! Haa! I dey vex say no moni for my hand all thru ds week, but u make me laff gan this afternoon. God bless u sis & Aunty Stella your senior for amebo gist....chop kiss

    ReplyDelete
  3. Sisi puleazzze I can't can't,🀣🀣🀣..Cash Scarcity revealing baby daddies too!

    ReplyDelete
  4. Breeze blow, fowl nor wear dross, na wrapper he tie for head..
    πŸ˜†

    ReplyDelete
  5. Omor!!!! Una see wetin emiefele de cause naa, revealing what should not be revealed, heyaaa, really pity the wife Sha, what a way to know her husband has kids outside, grandma sef no do well, all is well sha

    ReplyDelete
  6. Replies
    1. No comment about your ashawo brother spreading seed around

      Delete
  7. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣. God help us with this cashless policy o.

    ReplyDelete
  8. We abuse everything in this country.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141