Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Wife Wey Get Sense Na Em Dey Rain

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, March 02, 2023

Pidgin Post - Wife Wey Get Sense Na Em Dey Rain

 I just wan talk am as I see am oh... una see say woman wey get sense go follow use the popularity wey she get build her husband and then follow enjoy the proceeds......

If you want example i fit give you only two....



You don see actress Regina Daniels and her colleague Mercy Johnson? Dem use their fame help them husbands win seats for house of representatives.. Dem go enjoy am because the salary there a month plenty well well and then the men don get new status of respect and day job don land...Both of dem fit decide to dey there for the next 20 years.... Senator Okojie and senator Nwoko!.

Those of una wey be say na only bags and shoes una sabi buy make una learn from this two and begin build foundation... Regina smart pass tortoise and Mercy get wisdom of the forefathers...Una dey cuss one say e marry e ancestors and una dey cuss one say e thief person husband......Who dey breeet?

Make una learn from dem and stop to go dey all those toxic pages for Instagram, go siddon for page wey you go learn sontin...

Even if you feel say i talk nonsense but you get the message abi?

6 comments:

  1. Na better husband wife dey help

    ReplyDelete
  2. If Karma dey real, na up and coming smallie go still chop their husband as dem collect hubby from other wives na.

    ReplyDelete
    Replies
    1. It could be possible because those men can marry more wives

      Delete
  3. When Stella called the younger one "wise", some of you yabbed her.

    This isn't about money.
    Relative peace in the home takes more than noise making.

    ReplyDelete
  4. One of the best advice on the internet. God bless the writer. My sisters make una exit from those toxic naccist page from social media oh, na to tear your family apart be their end goal. Follow possitivity

    ReplyDelete
  5. Lol, after building him what next?
    Mercy will so regret this

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141