Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi - Bestie Palava

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, March 31, 2023

Sisi Senaponi - Bestie Palava

 Wonders shall never end!


Kpoi kpoi! I hail o!

Stellaoctavialapopo!...I salute o!

Wonders ehh...

Na so this broda Ifeanyi get one sister Georgina wey dem grow together!

Georgina get boyfriend but ifeanyi nor get as he nor be her speck, so na bestie she dey call am.

Small time, ifeanyi go dey visit her for her house, he see her neighbour Joana wey he like.
He begin follow Joana discuss love matter

Anytime he go their compound, na for aside or Georgina room dem go discuss.
As the love come stromg, Joana too come begin allow ifeanyi come her room.

She go cook for am and he go dey her side for long.
*anor know if na television dem dey watch abi na dem television dey watch o!*sideeyes!

Maybe, i for jump fence climb window o, see if person hang blokos for door! Nor vex!

Na im Ifeanyi go abroad with him family come back, everything wey he carry come na double double!
As he don decide to marry Joana, he nor come too dey go Georgina room like before, na direct he dey go her side.

Georgina go see Ifeanyi car aside, she fit go knock begin accuse ifeanyi say he no come visit her first before he climb upstairs come meet Joana.
Small time Georgina relationship scatter, she come become fish bone for Joana neck!
She begin monitor anytime wey Ifeanyi show.

She go enter Joana room, begin check anything wey fine dey ask say shebi na Ifeanyi buy and give her?!

Na so one day Joana say she wake up go aside, see ifeanyi car, she call am he nor pick, she go Georgina room, he say Ifeanyi dey sleep make she come back later.

Joana say she call him phone, na Georgina pick am, say he still dey sleep!

Na so the matter come reach where ifeanyi drive comot their compound,, he nor bother branch Joana room!

No wahala na! As Joana sef don zero her mind say, maybe something don begin hapun between them.

She nor follow Georgina talk anything, she avoid her completely.

In fact na that same month she plan to pack comot the compound. Make she dey closer to her office and forget ifeanyi matter!

The day she dey pack, Georgina go meet her, person wey nor greet her for one full month, ifeanyi sef block her number, e nor pick call, without any explanations.

Georgina dey ask her why and where she dey pack comot?!
She jor snub the Georgina, waka pass!

Na later Joana hear say Ifeanyi don wed Georgina for court and settle bride price gini gwanu! Choi! She cry nor be small!

The time wah know her na when she pack come the next street.

Her face dey swell pass person wey dem blow inside boxing ring!

She go cry sotehhh, person wey get frog eyes before, the thing go come be like she jor smoke weed!

She collect sick leave for office, dey house dey pray, dey cry!
I dey lock shop, go check her that time, to chop ordinary bread, wah buy go dey hard her!

Na only for naija heart break nor dey kee person, anor know the kain cement wey God mix, do am! Some people heart don break turn sawdust! Dem go still use am love Johnny!!

Na so she hear say Georgina kpai o! Say small sickness na im do her!

The belle wey she get for ifeanyi, wey she use to fastforward the whole thing, na when she kpai her former boyfriend begin follow Ifeanyi drag paternity something!

Dem drag am drag am go do test, na the former boyfriend get the boy!

Ifeanyi come find Joana go her office, he say he want make dem rekindle the firewood wey Georgina pour water!

Na me follow dem go bail Joana from police station when she carry better Akube koko shoe knack Ifeanyi for top of eye, wey blood full everywhere!

Na hospital dem carry am go use rope sew the thing!

If to say wind blow her hand come down small, na so he for turn babiala!

15 comments:

  1. @he for turn babiala...
    He lost at both end no wife no child
    Serves him right..

    ReplyDelete
    Replies
    1. You are an evil person with a black heart. What's heartbreak compared to human life...2 for that matter. Wickedness everywhere.

      Delete
  2. hahaha.... Babiala. this your wafi no be here. Its well with Ifeanyi and Joana o.

    ReplyDelete
  3. What effrontery Ifeanyi get? Na that him blokos she suppose cut off, nonsense and ingredients

    ReplyDelete
  4. What a wicked person Georgina is! That is why I avoid dating men who show interest in my friends or relatives first, even if those friends or relatives are already married to other people. From the stories I have heard, some women end up going back to those men they rejected for one reason or the other esp when the men become successful because they know those men may still have a soft spot for them. They don't care who they hurt in the process. They justify themselves by saying the men came for them first.

    ReplyDelete
  5. Joana my girl!!!!!!!

    How I wish say na Georgina that Koko shu meet before she kpai! But no problem, Ifeanyi sef deserve am.

    ReplyDelete
  6. Georgina no try at all o. Sisi well done o.

    ReplyDelete
  7. The man just succumbed to his lust for Georgina. I feel angry for reading this story. lol

    ReplyDelete
  8. I no no who do us sha, competition/envy/ bitterness no good o.

    That ifeanyi get mind sha. Joana baibay you will be fine laslas

    ReplyDelete
  9. Na wa. Envy everywhere. Now see as longer throat kill Gourginia

    ReplyDelete
  10. Abi Georgina give Ifeanyi something wey shift him eyes comot for Joana's...

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141