Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post -Police Catch Ogufe Thief Inside Church

Advertisement

Wednesday, February 25, 2026

Pidgin Post -Police Catch Ogufe Thief Inside Church

One 27-year-old thief wey dem say him name na Emmanuel Awahnse (a.k.a Ariwo Oja) go somewhere go thief ogufe, he come hide the ogufe dem inside sack but So-safe corps spot am with the bag and he come pick race leave the ogufe dem and the Okada he carry.......


As he dey run, dem mark am down come begin dey find am...
After dem find am tire, on February 19, 2026 as he dey inside church dey do em pikin naming ceremony, na so Police enter catch am for the ogufe dem wey he been thief....
Chai!!!
Dem don hand Ariwo Oja to Police until further notice...
Ebe like na the ogufe wey e go thief dem wan use do goat meat stew use wack amala with ewedu and gbegiri…

Chai!!!

10 comments:

  1. Thief Thief,thank God say dem catch am.πŸ™„πŸ™„πŸ™„

    ReplyDelete
  2. Lol... Big STELLA your pidgin na badazzz.. Ogufe wack Amala

    ReplyDelete
  3. Ogufe with correct body odor🀣🀣
    Omo ole

    ReplyDelete
  4. See disgrace on your own naming ceremony day on top OGUFE lol

    ReplyDelete
  5. So he thief ogufe to do naming ceremony? Na wah

    ReplyDelete
  6. Emmanuel o si Nile, omo ewure dagba- That will be the new oriki of their family

    ReplyDelete
  7. SDK, I love this reportage. I had a good laugh. πŸ˜‚πŸ€£

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141