Stella Dimoko Korkus.com: Waffy Proverbs.....

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, June 05, 2019

Waffy Proverbs.....

If the Waffy Forefathers didnt say it,then its not authentic...lol





1. Na person wey never see problem dey use good English dey pray.

2. Book wey no gree enter head go enta exam hall

3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set o.

4.who naked no dey shuuk hand for pocket...!

5. wetin concern dog wit family planning?..

6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

7. This one good, this one good na in mad man take dey gather plenty load.

8.Pikin wey go strong go strong.... No be until dem name am Samson.

9.Na over confidence naim make February no complete.

10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

11.Head wey no wan think go carry load..

12. Them dey hide craze man he dey blow whistle.

13. Forget Trust If trust dey, Water for no boil Fish....



These are Waffy proverbs,do we also have Igbo,Yoruba,Hausa or any other tribe's proverbs?

35 comments:

  1. 1.(Naija)Sisi wey stand outside, get persin wey she dey wait for 😜
    2.Cut suya, cut suya, na for nama bodi
    3. The race wey (Naija)sisi tear commot hands for her chest, wetin
    dey pursue am dey long 🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️
    4. (Naija)Sisi wey dey press phone for night nderi, if she no catch usu; bat, she
    go catch owl 😉😉

    ReplyDelete
  2. Crazy hilarious true words.

    ReplyDelete
    Replies
    1. No be today kwash dey back

      We don see plenty Christmas, easter no be news

      No teeth for rotten mangoes

      Abeg abeg I no fit shout

      Delete
  3. No number 2 correct wella. Dat number 6 na lie, na impatient de cause am. No 13 is everything. Sense dey inside dat yarn well well.

    ReplyDelete
    Replies
    1. when you do num 2, dem expell you fr school

      Delete
    2. Hahahahahahahahaha but Dede I no tell you say I do am na

      Delete
  4. Hahahaha at no 2.
    11 is the real deal mehn

    ReplyDelete
  5. tohtoh water no plenty, but e dey reach prick baff



    ReplyDelete
    Replies
    1. Pikin wey no fear carry e papa up, e papa blokos go cover his eyes -Igbo

      Delete
    2. Pikin wey no fear carry e papa up, e papa blokos go cover his eyes -Igbo

      Delete
  6. This reminds me so much of Pararan🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  7. this are funny and deep...was it olori that posted in IHN yesterday?

    ReplyDelete
  8. Waoh! Educative, lesson proffered yet funny..

    ReplyDelete
  9. choke me zaddy, choke me zaddy na im pussy take dey wide

    ReplyDelete
  10. E go come down, e go come down na I'm butterfly take enter Bush.

    If you no pull meat, pepper no go enter eye

    If nyash shake, waka don start be that

    Persin wey get big scrotum say e no pain am, neighbour say I'm no fit sleep because of the scrotum.

    Choi, I try o.

    ReplyDelete
  11. carve my hair lining well, na im head dey take wear V-neck

    ReplyDelete
  12. Nor be by big dick them take Dey born twins

    Tortoise know say house rent cost too much, na e make am carry e own house come life

    Difference dey between bathroom and baffroom. If ur soap fall for baffroom, u nor dey pick am again😂

    Pikin when Dey find party rice not suppose to fear dance oo

    Goat know say the waka waka wey dey dis life plenty well well, na e make am wear shoes come life

    Who dey sell pepper no dey use hand dey scratch pri*k



    Just felt like jumping on this from the ones I know from way back😁




    ReplyDelete
  13. Wetin concern bicycle with fuel station. Them dey use mouth put fish for pot 😂 😂 😆

    ReplyDelete
  14. Wetin concern bicycle with fuel station. Them dey use mouth put fish for pot 😂 😂 😆. Person wey wear white no dey near red oil. Elder wey say make children no eat rat, make him no use teeth share am give.

    ReplyDelete
  15. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dey pass tru make dem diffrent

    ReplyDelete
  16. Nah area Warri boys take dey gather.
    Nah yansh Warri girls dey use break karnel.

    ReplyDelete
  17. Pikin wey dem use Warri or Sapele water baff dey sabi, as in dem be "sabi sabi"
    For University days, so this my Lagos friend dey friend one Benin guy, the girl come dey try blend into the Pidgin level, sotey she come dey use past tense dey speak Pidgin.
    The thing can vex the guy ehen.
    Naim my friend come ask me with vexation one day, if pidgin English no get past tense, say her guy say make she come ask me, from day l begin dey teach am, how to blend.

    ReplyDelete
  18. No be today yansh get center parting.
    Na woman wen neva see problem dey hold breasts dey run..
    Dey nor dey tell deaf and dumb say market don close ...
    Fish when nor eat worm for hook well, go enter pot..
    Fall for me, I fall for you na dog play take dey sweet..
    Na the same teeth when lion take dey carry him picking Na he take dey kill animal..
    Fine girl, fine girl naim ashawo work take dey start...
    Ashawo wen nor get sweet mouth na hungry go beat am..
    Na sweet mouth dem dey take sell rotten fish..
    Na for morning dem dey take sell fresh fish...
    Na hand dem take drive mosquito wen perch for bloggous...

    ReplyDelete
  19. No 13 is deep..funny proverb, I was just smilling all through.

    ReplyDelete
  20. Na from play play clap Dey turn to dance.
    Dem no Dey tell old woman to close leg because you nor no where she from Dey collect breeze.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Different type of ventilation
      All manner of breeze dey

      Delete
    2. Any cough wey no comot from mouth
      Na another tin e don be

      Delete
  21. Wetin concern fowl with toothbrush
    Wetin concern vulture with barber
    Na from clap dance dey take start
    To craze nor dey hard na the trekking be wahala
    Madman sef won barb hair na chance nor dey

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141