Stella Dimoko Korkus.com: Naija Boy Wey Wan Marry Woman Wey E Meet For Instagram Say E No Go Fit Love Naija Woman Again After Wetin E Taste..

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Tuesday, January 21, 2020

Naija Boy Wey Wan Marry Woman Wey E Meet For Instagram Say E No Go Fit Love Naija Woman Again After Wetin E Taste..

26 year old Isa Sulaiman Panshekara wey wan marry 46 year old American citizen Janine Sanchez tell BBC for exclusive interview say e no fit love any Nigerian woman again after wetin e don taste.






"Di truth be say our women no sabi wetin be true love, it is either dem dey eye somthin or dem get plans but if white woman tell you say she love you, bros she mean am from di bottom of her heart."

Di former barber say fear catch am small after Hisbah and DSS invite am go dia office but say na just advice dem give as per say media just dey carry im news anyhow.

Di couple first meet for Instagram about one year ago...

"We meet after i start to follow her for instagram and if she post pishure i go like am, den afta small time I come see say some Yahoo boys dey try scam her, so I send her message say make she no mind those pipo so dat tin come attract her, e show her say na honest pesin I be. Na dat one first attract her."

"From dia we come dey chat wella, video calls and na all dat one lead us to this level wey we dey."

On whether dem don sleep for di same room since she come Kano 6 days ago.

"We no dey sleep for di same room, i dey stay with her till night before i go tell her good night, even dis one wey we dey do (small hugs and holding hands) pipo dey tok tokless of sleeping togeda."

Isa say im family don agree for am to marry Janine and by March di wedding go hold before im and im wife move to America.

"Afta di wedding for March by God's grace na US straight for dia I go get work, go back to school na just secondary school i stop and hopefully get soccer team wey i go play for."

On her part Janine tok say dis na her first time to visit Africa and she happy with how pipo dey treat her. She say e sweet her for belle say Isa family don gree for dem to marry.

"I don meet im family more dan 100 of dem and e sweet me say all of dem gree for us to marry, many of dem neva see white woman before, na so dem come dey play wit my hair, dey touch my hand."

Di chef for California wey dey work for Afghani Restaurant, say she dey go back America next month before she return by March for di wedding.

"I dey go back by next month and i go return for March for our wedding before me and am go move to America finally."

Finally Isa yan say im love wit Janine na proof say true love dey exist for social media and e good make pipo dey try dia luck.

38 comments:

  1. “Our women not sabi watin be true love” such nerve to generalize 🀷🏿‍♀️
    As if he himself is actually inlove with the woman.
    That your waist go hear am.
    Please go and marry in peace and get away with your generalization...Aboki πŸ™„

    ReplyDelete
    Replies
    1. ....and Nigerian women are gold diggers.He forgot to include their normal chant...maybe because he is also a 'Nigerian women'.πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

      Delete
    2. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ Kami
      Be cracking me up ce matin

      Delete
    3. And he is the biggest gold digger ever, he think American Embassy will quickly grant him visa. They understand the game wella. Go and marry your grandma in peace. Okpo!!!

      Delete
    4. Because Nigerian woman wont give you their money na. This oyinbo is ever willing to be the husband, raise you since ur still a child and even sponsor your education. lazy Nigerian youth, hahahaha.

      Delete
    5. Lmao
      Stories that touch the heart and tickles the bumbum

      Delete
  2. 😁😁😁😁😁

    ReplyDelete
  3. And by the way issa, stop bad mouthing Nigerian girls, you sef dey eye something for this marriage 🀷🀷

    ReplyDelete
  4. With this face and mentality; on behalf of all Naija women we hereby donate you (with no terms n condition) to your white woman and any other one at that!!!

    ReplyDelete
  5. scammer. after guy man succeed na race. yimu

    ReplyDelete
  6. Make we siddon dey look the love with our eyes

    ReplyDelete
  7. Lol
    "Someone I know" said I should tell you that it's the same with sex. Say when you gbench with oyibo babe, you no go won gbench our Naija over sabi boring fighting and struggling before sex and during the sex session girls again, making one not to enjoy the process. How the brother no go get quick ejaculation after the whole fighting..when him just won rush to cum so he can leave you with your wahala. Later una go dey complain of 40 second man.. you'll never see a Naija girl that would agree she lovs sexπŸ˜‹.. "I won't suck your dick.. no, I'm not doing that style..I'm not a prostitute..is it sex sex sex everytime" πŸ™„.. after the boring sex them go come give you billing lol..
    But oyibo bebe ehn, including asians.. and some African countries S.A, Ethiopia, Ghana too to some extent.. the sex session is open.. no holding back from either parties.. blissful sex lol.

    Terms and conditions apply tho

    ReplyDelete
    Replies
    1. This your English get as e bi.
      next time talk pigin.

      Delete
    2. Not all Nigerian women... I am not ashame to say I love sex and I am not also ashame to say how I like to be satisfied by my man.
      I don't shy away from having the sex-discussions.

      I only enjoy and accept sex in a legal relationship (I still believe in sex after marriage)

      Both Nigerian men and women (most) have insecurity complex when it comes to having sex talk.

      Delete
    3. when you idiots like to judge and bastardise the naija women that openly like to have sex nko?? babes gat to change format na on top say nigerian men are judgemental morons. you can't eat the cake and have it

      Delete
    4. @Ms A,I believe you. That's why I wrote that disclaimer at the end. It's different with Naija girls that are more exposed and have growth in their lives.

      "Someone I know" have noticed that it's mostly those girls who have nothing else apart from sex to offer in their lives that toe that path.. they did be like- "Chai, this is only thing this boy can gain from me oh,won't I become useless after he gets it?..let me make him suffer for it so he won't think he has gotten the whole me".. and boy! We have a lot of them right here. Entitled lots, dem even carry the entitlement enter the sex sef, they don't care about pleasing the man, all they want is for the man to struggle through the session and for them to pretend to fight him off then later lie like a log of wood for him to please them.. and after, attempt to guilt trip him with their famous quote- "shebi you have gotten what you want".. then they'll still have the nerves to come under anonymous and comment about how the guy is a 40 seconds man.. like they're not the cause. Continue playing and cheating yourself..

      Is there's an anonymous that just called her father an idiot.. would she be kind enough to read through this comment and see the category she falls under.

      Blessings

      Delete
    5. Dante the expert
      Wehdone
      πŸ‘πŸ½πŸ‘πŸ½πŸ‘πŸ½πŸ‘πŸ½

      Delete
    6. 'shebi you have gotten what you want' the most famous quote of naija ladies.

      but two days later you receive billing: 'my younger brother want to pay skol fees' or 'i want to buy infinix hot 20'

      Delete
  8. Good. We naija women hereby donate you. Be gone!

    ReplyDelete
    Replies
    1. Most of them that complain no sabi. 🚢🏽‍♀️🚢🏽‍♀️🚢🏽‍♀️

      Delete
  9. On behalf of Nigerian women, we donate all scammers to the whites. Nonsense! Will the family accept her if she was Nigerian? The whites you are chasing are desirable because their society made up of men made things better for their women.

    ReplyDelete
    Replies
    1. They are after what they will gain from the woman. Many of them whities have fallen victim, but they still will not hear.

      Delete
  10. My fellow women,make una no too vex for Issa,
    Before before, I believe say love dey blind but this Issa own don make me see say him own love dey shine eyes. e love sotey e see say naija woman no sabi love.

    Dem no dey tell person when him power want finish.

    ReplyDelete
  11. Na here we dey. Oga Issa, enjoy.

    ReplyDelete
  12. Na sit-down look mode πŸ™„πŸ™„

    ReplyDelete
  13. My own be say make Boko haram no find this woman kidnap. I no fit fight America mbok.

    ReplyDelete
  14. Here the boy is saying the truth.
    Naija girls are greedy to stupor
    They are always eyeing something -money or abroad.
    But this boy is also eyeing abroad here.
    That's the truth.
    πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
    Replies
    1. The boy is saying the truth, yet eyeing abroad πŸ™„πŸ™„πŸ™„πŸ˜Ž

      Delete
  15. Stella, please write or do a post about Africans dating or married to Caucasians. I am so attracted to them. I am a female by the way and my siblings and cousins are married to them as well (All females too). Caucasian men aren't saints but they are "sweet" and this is having dated most races. I would like to read other ladies imput on this.

    ReplyDelete
  16. A chef in an Afghani restaurant with two kids is the one that will put you through school, pay for your football training and continue paying her bills and mortgage? I don't mean to go all ANG but I'd just like to be clear. I'm assuming more kids are also on the way right?

    Thankfully, he has given his verdict on Nigerian women do the wise ones will know how to comment on his future chronicles.

    Is this boy aware that not every American is a millionaire?

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141