Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Pasitor Don Cause Gbege For Wia Dem Send Am Go Preach.

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, March 07, 2021

Pidgin Post - Pasitor Don Cause Gbege For Wia Dem Send Am Go Preach.

  One pasitor for one church for Naija don cause big kasala for one community and na the matter dem still dey try to settle so...








E never too tey wey dem carry am come for the community to come do him pasitor work. 


So e get one fine youngy woman wey carry her pikin wey she just born to go dedicate with her husband. Church pipu no know sey as oga pasitor dey dedicate this woman pikin, him eye dey enter the woman too ...

 hmmmmmmmm. 


No do, no do, as time dey go small small, pipu come dey see as the woman sef dey come oga pasitor house dey do some kind things for am...

 she dey cook, dey clean, sometimes go dey tilli night before she go house. Her husband sef no sabi sey this kind thing dey happen sake of sey him na bus driver wey dey commot for early moin moin dey come back for night. 


Hmmmm, naso amibo them open their ear, dey shine their eyes like torchlight sake of sey dem wan really know wetin dey shele between oga pasitor and oga John woman. Naso this pipu torchlight this matter come find out sey cockroach dey inside cupboard o.

 Trust correct church amibo na, naso them pass back go tell oga John wetin their eye see. 

Oga John sef come pretend like sey him go work, as him wife commot go pasitor house, naso oga John catch them where them close door kpichikom๐Ÿ˜. 

Heeey matter long o, but to cut am short e, oga John wife look her husband eye ball to eye ball tell am sey she no do again, she no wan marry am again o, sey na pasitor wey her heart and lovi lovi dey for. 

Pasitor sef tell amibo people wey gather to hear the matter sey him wan marry oga John wife, sey him like her well well๐Ÿ™†( na wetin dey send you come do be dis, to come browse anoda man wife network, shior). 

Dem still dey press this matter as dem dey press cloth

13 comments:

  1. Inside life. Weyrin God go judge for this life plenty ๐Ÿšถ๐Ÿšถ

    ReplyDelete
  2. This one na wahala for Oga John. Women dey gberekete make Oga John go marry another asa .

    The most Complex B

    ReplyDelete
  3. ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ kaแป‹, this tori sweet me no be small ooh!
    Amebo dey sweet.
    Na this one our long before before BV go call, end time pasito!
    Naawaoo!!

    ReplyDelete
  4. No be small thing pastor don colobi member wife ooo omo see gobe!!!

    ReplyDelete
  5. "By them fruits, una go sabi them..." Na so Jesus yarn am.
    Them no be Jesus pasitors, na them call themselves and na themselves
    for flesh them dey serve.
    So na from where this tori waka commot?
    Na which press pipul they press am like cloth commot?
    Abi na Stella's network of amebo reporters?
    ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃfreelance amebo reporters๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜

    ReplyDelete
  6. Na wa for wire road oh... Nothing this generasun pasitor no go do

    ReplyDelete
  7. Dis pastoir na man of devil... Chaiii. See as he scatter oga John marriage...

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141