Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Sharing Formula

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, April 22, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Sharing Formula

 Make una dey drink water dey read dey go!!!





Kpoi! Kpoi! Kpoi!

Una SDK yard pipu dem dem I greet o!


Na so I dey room begin hear noise, I comot see say three corper gehs don comot boxers from Landlord body! Wetin hapun? Make una leave am! Una dis generation nor get respect o! Why una go drag landlord comot from inside bathroom?!


Fiam! Na im landlord run enter my room, lock door from inside!

Oga landlord, na 6 pieces of meat dey inside my pot o! Nor say I nor warn you o! Me I dey beat Adort o!

I face the 'konsensus of an excuse'! I say wetin hapun o!?


Dem say landlord say he wan chop the three of dem at the same time, so dey charge am N100k each, he do finish, he come carry Five hundred naira give dem one by one!

So dem seize him clothes, phones and house keys say na until Landlady come, before dem go give am!


I look dem, shame catch me! So if this landlord give una N300k una go collect? Den say why not?! I say when rain dey fall, una carpet nor dey float? Nor be this same well una dey come fetch water?! Una see battery inside him wristwatch?! Him dross nor dey smell? Hope una know say he go still collect N200 change?



I enter my room, I see say landlord don make himself very comfortable! He tanda behind the door. He don wear my pink polo (dat one sef tanda on top him pot belle), tie wrapper join. He even wear my pink dunlop.I ask am if mah kukuma give am headtie or bonnet join!? *Yeye man!*



Na so I go back out, I ask dem if dey no know say landlord na ritualist?! Dem begin look demselves?! I say he jor confess gimme say he wan use the three of dem, na why he knack dem!

Make una come see shout! Cry! Cover mouth! Going In and out, dey swear for the landlord!

One say make dem quick go see her pastor for church, the second one carry hand put for under begin chant incantations. The third one dey knock Reverend Sister door!


I still dey look dem, when I see person dey sneak comot from oga harvest room with wrapper, dey tip toe, go turn pass staircase.


Tor, I kukuma open my door tell landlord say landlady don come o! Say thank God na inside Oga harvest room she from comot! Say she nor too waka far! Meh he carry himself comot for my side, I wan enter market abegi! I shout give Landlady meh she bring dross come for her husband biko!



Landlord fly comot from my room begin bang on top Oga harvest door! He say make dem call carpenter for am! Say he go uproot the door! *Hian! Person nor fit chop your own, but you sabi carry toothpick ontop another!


Na there dem dey o! With man wey tie wrapper, wear crop top! I wan hep am find headtie and Make up Artist wey go match him combination. *clickstongue*




Na wah for this compound pipu...

15 comments:

  1. Story story .. story.
    This na face me I slap you compound oh

    ReplyDelete
  2. Sounds fabulousπŸ€“

    The story sweet sha, your pidgin make sense.

    ReplyDelete
  3. I dey try imagine the story, e come be like fiction for my ear.

    This one na house of commotion.... Everything no just follow. Landlord, community di*k, landlady? no shame, tenants... talk for another day.

    ReplyDelete
  4. You don cheer me up. Thanks

    ReplyDelete
  5. This one sweet die hahaha. Well-done

    ReplyDelete
  6. This na real Fuji house of commotionπŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  7. Na barracks you dey stay? Na dem dey get plenty tory

    ReplyDelete
  8. I dey read dey laugh,una landlord na werey.

    ReplyDelete
  9. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
    This one pass fuji house of commotion.

    Make everyone one for that compound repent oh. Jesus is coming.

    By the way SISI Senaponi, you nko? You too no dey do?? πŸ™„πŸ˜πŸ˜πŸ€”πŸ€”

    ReplyDelete
  10. Enter your comment...πŸ˜‚πŸ˜‚,God dey watch all of una for 3D,but come o, why e be say this kain thing dey common for face me,I slap you?

    ReplyDelete
  11. E be like say I go come do holiday for that una compound o 🀣🀣🀣 everyday yawaπŸ˜‚

    ReplyDelete
  12. This your compound really get as e be oooπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  13. I just dey laugh. Yeye corpers wey no get shame.

    Landlady n landlord....I pity em pikins dem.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141