Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Main Versus Side Torotoro

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, May 09, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Main Versus Side Torotoro

Hilarious!





Issa kpoi! Kpoi! Ooo! Na who dey o!


Stellaencanto! I hail o!


Make una hep us and praise Master Jeezezz eh!

Oga harvest don finally import him babe come from PH! Finally, all dem small small gehs for area go sidon their papa haasee e!


I dey come from shop, open gate, see Landlady dey attack Oga Harvest Babe (Catherine), she say why she go carry her bucket wash clothe?
Cathy say na since Oga Harvest too dey use am na why she carry am!


Stella, I too tayad abeg, na my door I face, mah go lem this Garri wey dey my hand! I nor get intestine for problem biko!


The following morning, na church bell wake us for 5am! Wetin hapun? Na rapture? E nor fit be?! Angeh nor fit geh mind enter this yard! If dem no thief him dwess? Den go thief him wings or trumpet! Abi dem thief am remain bell?!


Small time we rush come outside, na oga harvest babe o! Catherine carry bell dey ring for backyard!


Aunty? Na wetin dey occur?!


Catherine say, una thank you say una hear my call una answer! She say make everybody nor bother come house come sleep for night o!


You say wetin?
She say because she wan commit murder!


Landlord say wetin be all these nonsense!

Na im Catherine continue, she say, 'oya landlord, carry that broom begin sweep from front yard reach dis side'!

Fiam! Landlord tie him Agbada for head, carry broom begin sweep! 

* wetin be dis!*


Landlady begin vibrate! You this ogbanje! You must leave this yard today!


Catherine face me say make I sidon near Well. The well come resemble Executive chair for my eyes, me sef sidon!


She face landlady say you! I don dey look you since I come this yard!

You dey chop wetin be my own wen I no dey! I still come here, you still dey gimme headache!

Say no more!

 She tear landlady slap! Landlady turn to turning stick! She carry am fling over the fence! I hear the stick hit Alfa wey dey next yard for head!

Come be like say she turn me to rabbit, as carrot begin hungry me! Be like say I even get tail join!


Person begin ring bell again! Who be that again?! Na im I open my eyes o! Na dream!


I come begin hear the bell for real life, na him I peep window see Catherine wey carry bell for one hand, hold cutlass and cane with the other one.


Devil nor be me and you! I quick off torch, close window! I nor dey house biko!




Hahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahhahaha the words are so funny OMG!!!

20 comments:

  1. Kuku kill mehhahahahahahahha my chest!!!

    ReplyDelete
  2. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  3. Na under table i read am...no be becos of you dem go pursue me from work 😂🤣😂🤣😂

    ReplyDelete
  4. Nka atom piece 🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  5. So funnyyyy😂😂😂😂

    ReplyDelete
  6. Sisi go hide under ya bed o. haahahahahahahs-

    ReplyDelete
  7. Lol🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  8. You this geh😀😀😀😀😀

    ReplyDelete
  9. 😂😅😅🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  10. 🤣🤣🤣🤣😂😂😂I don laugh tire

    ReplyDelete
  11. Why so funny??

    ReplyDelete
  12. Hahahahahahaha
    Sisi you should be given an award
    May God bless you and bless aunty stells too. Stella you have the sweetest heart, please how can I send you recharge card aunty stells

    ReplyDelete
  13. Hahahahaha 😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂

    ReplyDelete
  14. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣 my chestttt

    ReplyDelete
  15. Farah Spicy 🔥10 May 2022 at 13:14

    Lol very funny

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141