Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The Matter Shock Me.

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, July 01, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The Matter Shock Me.

 Ha!!!





Kpoi! Kpoi! Kpoi! I greet O!



Stellamamalade I hail O!


This mama Timo wey get Canteen for inside market, her story be like person wey dey hawk bread, get crawcraw for under, come sidon on top bicycle inside Lagos traffic.


The time wey I hear her tori, na so my mouth open, I no fit close am.


Na virgin her husband marry her from village o. Na for Aba the man get shop, dey do well.


Small time as she don born finish, her husband begin find wetin nor miss outside.
Na so the husband jam one woman wey sabi speak queens English.


Papa Timo begin dey travel every other week.
As phone nor too dey back in the days, na when person see person, person see am O!


Small time na im papa Timo come sick o! Serious one wey dem put am for hospital 6months. Na that time one of his kinsmen come hospital say make Papa Timo send person to him other wife and children for Lagos. Say shullincase say him time don dey round up.


Na so Mama Timo hear say she get junior wife o. 


Dem say when the woman even come, na two twins she sef born like Mama Timo. The woman say she get work so she must to return the following day to Lagos.
The woman leave the four children put for Mama Timo neck say make dem sidon their papa house!


Hmm...mmm, abeg una wey no dey respect nurses, way una go dey run una mouth anyhow. Na God go forgive una O! Nurses eye dey seee Abeg!


Na the day wey Mama Timo go one corner wan drink poison for back of hospital, she no know say one nurse don dey suspect her. Na the Nurse save her life O! Na the same Nurse people say come give Mama Timo 'something'.


Me I no dey dia O, na just the evidence I fit testify. *clickstongue*.


Dem say as Papa Timo recover fully like this, on top say he still dey use one walking stick, he say he wan go Lagos go meet him junior wife, say Mama Timo na badluck.


This man no even know the kain 'Air force' offer wey person give Mama Timo way she refuse On top say she no wan go that side.


Na the same week wey Papa Timo comot, wey Timo and him twin brother kpai!

Ordinary malaria wey she nor get one kobo carry buy medicine complete for the twins!


Na wetin dem say come vex Mama Timo wey she join Air force O!

Na without invitation, Papa Timo come house, carry all him money come back house.
Mama Timo start business, even do this canteen join.


Na after Papa Timo come back house wey dem born this fine boy wey get coconut head like him papa. Dem even carry the two names of the twins give am, but na Timo we dey call am! Him mama say na Timo come back again with the same birthmark for back.


*things dey happun abeg*


Small time Papa Timo wan become Chief for village, dey say make him bring him wives and the children come. He send person to bring him junior wife and the children.


For the traditional things wey dey wan do, na im the Priest say the four children na for another man. Eleeeeh!


Abeg how pikin go resemble person facially and no be him born am! I no dey understand O!
Na so junior wife carry her kaya disappear comot for village o.


Mama Timo balance begin prosper, her husband go leave him sales boys for shop, balance put for him wife side. Na as dem dey import rice, na im dem dey import beans....ololololoooo!


People say na that nurse give Mama Timo 'something', some say na Air force she go join.

At least I no dey see Papa Timo dey turn Amala, or wear uniform like the sales boys. He get him chair for office wey he dey monitor inpexdinchur and expendinchur! 

Husbands supporting wives since 1970 *sideeyes*


Make i go drink my tea wey remain biko!



*How does joining air force help her? I dont understand... Wetin Nurse give am?

15 comments:

  1. Lol Stella, airforce na witchcraft na..dem give her goodluck according to the story

    ReplyDelete
  2. Joining Airforce means witchcraft Stella

    ReplyDelete
  3. Why Papa Timo still dey gum body with mama Timo after wetin him do,He shuu geddifok!🤨

    ReplyDelete
    Replies
    1. Now I get it @love
      Beht why mama Timo go jus waste"airforce"ontop man like papa Timo🤮

      Delete
  4. I no too understand, if dem don give Mama Timo 'Airforce', why her pikins still die?

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na because them die she vex go join Air force...

      Delete
  5. This story sounds funny but it's playing out in my family home. Hubby slept with all the maids/sales assistants even impregnated some, wife stayed put and went into juju to chase the women away desperately wanting to be the only wife until she accepted 'something ' too from a 'good samaritan'.
    Now hubby has been relocated permanently to the great beyond after sucking his blood dry while wife has donated three of her children as sacrifice to her members.
    I keep wandering to what end is all the adultery/juju/ witchcraft.
    It's really tiring honestly but the battle continues

    ReplyDelete
  6. This story sounds funny but it's playing out in my family home. Hubby slept with all the maids/sales assistants even impregnated some, wife stayed put and went into juju to chase the women away desperately wanting to be the only wife until she accepted 'something ' too from a 'good samaritan'.
    Now hubby has been relocated permanently to the great beyond after sucking his blood dry while wife has donated three of her children as sacrifice to her members.
    I keep wandering to what end is all the adultery/juju/ witchcraft.
    It's really tiring honestly but the battle continues

    ReplyDelete
  7. Cont'd
    The two children remaining have abandoned wife and are fighting tooth and nail( with Christ as their rock) to defeat the demons unleashed by the wife while the house the wife fought all the women off for is currently desolate.
    See how a whole family is destroyed because of one man's reckless behavior/ lack of discretion and the wife's desperation and search for help from the devil.
    I honestly wish Stella would make a post on something like this. You will be shocked when you hear stories of how people are suffering as a result of their father bringing ants infested woods home.

    ReplyDelete
  8. So all the second wife children,no be papa Timo give her the belle? nawaooooo,umu nwoke sef.

    ReplyDelete
  9. Air force na witchcraft I think .....

    ReplyDelete
  10. Things dey hapun inside life abeg! Men and their wahala with cheating ehn! Tufia!

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141