Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Waist Bead Wonderment

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, August 22, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Waist Bead Wonderment

 Baby men dem with boxers wey moskito fear pass flit! *side eyes*  






Una kpoi kpoi kpoi e!


Who dey area? Stellalamba, I hail o!


Hmm...


For the compound wey face our yard One young girl wey dey Poly been live with one of her female friends!


Small time, one young man begin find her come. He nor too teh wey he buy her car!


Everything dey go well, until one day wah dey waka pass! *sideeyes*


No be say I waka pass like that, like that...I don already pass, so I come re-waka again, as I sight the man inside him car on top phone, as he dey vibrate like vulcanizer engine!


He begin shout! Make she nor call my number again! If I like, I will not send money or even bother to see my children for another ten years! It's my business not anybody's!


Hmm...confuse come catch me, so I begin watch the man with my spynoculars!
Turns out that, this man get wife and children for house!


Be like say something cause fight between him and the wife, so he come port sinceee, and turn himself to Bachelor without divorce!


He carry money dey spend anyhow for the young girl, begin threaten to abandon his children!


Anor even know as emotions just carry me that day, wey I remember some of my schoolmates when we dey Primary 5, wey their Papa abandon, carry another woman children train for expensive private schools!


Na one tiny white beans inside nylon, the three of them go share during breaktime. Sometimes sef, the food go don spoil, but they go still lem like that!
Because of them, I dey corner extra Garri with vegetable soup go school!


As my Mama don suspect say I dey carry food share with person, sometimes she sef go don add extra fish or meat! I go reach school begin confuse if my fish get belle, born pikin for road, inside plastic! *Children sense...God abeg e!*


For our school, Person must to Lem well and gather energy to chop cane and cut grass!
Shullincase, the noise makers decide say, heaven nor go rest until they carry all of us enter trouble, for headteacher hand!


Plenty cane wey person just chop for another person offence! E don tey wey injustice don dey this life!



Nna ehn, I just talk one prayer for my mind as I come waka pass the car, go my side say 'God abeg, for the children!'


Today wah dey follow Aunty Peace wey like problem pass repentance talk for frontyard Na so I sight the young girl with her friend, come down from keke napep, wey she carry black scarf cover face enter compound!


God of wonders! Na so I even remember say, I even get customer wah nor see for Mass last week, inside that compound.


Aftoroh, Bible say be thine neighbour's keeper, e nor matter if the neighbour na tennis or football! All ball na ball and I no mind to carry mat sidon inside post! *clickstongue*


Anor gree make Aunty Peace follow me enter, as na everywhere she go, person husband dey miss! Abeg my hand nor dey!


Na for staircase I begin hear the young girl cry, her friend tell her make she nor jump downstairs o! *yinmu* this one wey like soft life pass bedbug! Which kain yeye jump! *Akuko!*


Na im I say, young lady, it is not the end of thine road! (I see Karma wey tie fine wrapper, carry cooler wey dey comot hot hot steam, tanda for roadside dey wave you, with cane wey get 2 heads!-*inside my mind*)


I say your way still dey very lonnnng o! (So she sef go live long and marry, and see wetin 'roving eyes' dey do housewife for body!- *inside my mind*)


Wetin hapun? Oga give her punching out of nowhere for public...eye opening things! *Hian!*


Abeg that 'westbead' wey these girls dey wear upandan, get person wey suppose dey tell them say 'e get where o'! (Mean say, e get where the bead battery dey low'!) As power pass power!


As this young girl bend back for Balcony like this, remain small wah for shout!


Even Babalawo pikin nor get incisions for west reach like that! Anor fit close mouth!


I quick comot my hand, go house wash and detoxify my eyes with the blood of Jesus!


So ontop all the one wey dey round her west, oga still collect him car and launch her with punching as parting gift?! *wonderment!*


E get wetin I begin wonder, be like some people dey like off light when dey wan first do! Make God no see them, snap photo as evidence for judgement day ba?! *see sense!*


First time wey person eye suppose ON like floodlight! Even if Nepa no show, carry Lantern! To check and balance! As anor understand how Normal man go see this kain thing and not fear!


Na so corper for yard come house one time like that, say her 2months old Bobo get serious Eczema wey resemble Map of Libya from him groin area spread to the thighs!


E nor dey baff?! E nor dey smell?! 2 whole months of fornicating?! Under nor dey scratch you sef?! Na wa o!


She say na inside dark dem dey always do! She say na as she mistakenly drag duvet comot from him body as he dey sleep, she look back see am!


I say you nor dey see am scratch?! She say na 'pack' e dey 'pack'.I say that one nor be 'pack' Na sense he dey use scratch him blokos! Go meet Matron do serious test! Carry your Mumu Bobo go there too! Fit be Blackmarket Gonokoko e go carry!

Babymen dem with boxers wey moskito fear pass flit! *side eyes* HAHAHHAHAHAHAHHAHAHAHHA


Anyway Oga sha don go back house to him wife. Pain me say anor sabi the wife, afor tell her make she carry am go do deliverance plus serious Hospital Tests as only God know the kain entourage wey don build habitat for him terrain! Make she nor go carry wetin nor be her own!


Young lady don resume keke napep movement, until her west go catch another prey, na hia we dey!

25 comments:

  1. Thank God its ended well for the wife. Na wa

    ReplyDelete
  2. 🤣😂😂😂😂😂. Thanks for always making my day with this .

    ReplyDelete
  3. God have mercy
    Some wives have suffered.
    Some men will just go outside and bring termites into his home.

    ReplyDelete
  4. 🤣🤣🤣 Every jazz and medicine has an expiry date.

    ReplyDelete
  5. Good, he went back to his wife.

    ReplyDelete
  6. Sisi u be case o. Offing light for God not to snap for judgement day. Hahahaha.

    ReplyDelete
  7. 😂😂🤣🤣this ur pidgin English is wonderful 🤣🙏

    ReplyDelete
  8. Sisi,.you carry A1 for amebo. You too much abeg. "so I come re-waka again" hahaahahahaahha

    ReplyDelete
  9. Lolzz.... If some girls open body for your hmmm.. na incision full everywhere.
    You see beads wey some people dey wear for hand, leg and waist ... No be all be ordinary bead and chain o.

    Men make una learn to Siddon one place.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Dem go hear?
      Misadventurers

      Delete
  10. 🤣 I’m glad the story ended well

    ReplyDelete
  11. Hmmm, the things people experience daily

    ReplyDelete
  12. The way young girls are doing Residency with Herbalists and Seers ehn. Na who no sabi pray and hold God for leg dey jonze o!

    ReplyDelete
  13. This your pigin thick welwel😁

    ReplyDelete
  14. 😂😂😂 your tori dey sweet wella

    ReplyDelete
  15. Sisi Sena with the hot hot gists

    ReplyDelete
  16. No wahala. Any man wey boast say him get three head go see am take carry plenty dirty load.
    Who never see wahala no dey get sense sonetimes.
    Na God way sure pass!

    ReplyDelete
  17. Young boys: Yahoo plus
    Young girls: waist beads and incisions.
    No problems, at adulthood na Dem go marry themselves. 19 yrs old carry car give Mama and she go dey dance dey thank God.

    ReplyDelete
  18. 🤣🤣🤣🤣🤣 Sisi is the best pidgin story teller!

    ReplyDelete
  19. men wey nor dey luk tutu or waist dey shook prick una dey try. I get one frd wey serious cray cray cover her tutu go rich pelvic region.she say na aftershave bumps but I sha no say dat one nobi bumb as she get like 10cray cray for her back end of her spinal cord.I don tell her make she go treat herself or make she nor come my house b4 she go spread am give me.

    ReplyDelete
  20. Thank God it ended in praise for the wife. Nonsense girls

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141