Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - See 26 Year Old Thief Wey Thief 26 Generators

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, June 03, 2021

Pidgin Post - See 26 Year Old Thief Wey Thief 26 Generators

One ogbonge thief wey dem call Opeyemi Tosin wey be 26 years thief 26 generators and him and him friends wey dem call ThankGod James (22years) and Sodiq Segun(23years)  carry the 26 generators go sell but Police don arrest dem and parade them with the things dem thief.....
 





Police say he don confess say nah since 5 months e don begin the thief thief work wey he leave clothes washing business to start.
 
  Police say Tosin say if he wan thief, he go first shine him eyes look left and right before he carry out the thief.
 
I dey think now whether the punishment suppose be the same number as him age...
26 month for jail? 26 strokes of the cane?26 million naira fine? which one e go be?
Dem no dey sorry for thief oh, e dey dia blood, once you pardon dem ,dem go enter town go thief again!

5 comments:

  1. Yes o, thief thief dey dem blood but when them receive Jesus into them lives, na Jesus blood go wash away thief thief for them blood.
    Me self dey thief my papa money before but since Jesus come enter my life, years ago tey tey, I never thief again.
    In fact, I don return up to 5k dollars wey I found lost to the owner.
    🤷‍♀️🤷‍♀️🤷‍♀️🤷‍♀️🤷‍♀️🤷‍♀️

    ReplyDelete
  2. The guy is good. He no west his age. He.complete am well

    ReplyDelete
  3. Make dey burn am with 26 tyres.

    ReplyDelete
  4. Nah birthday marker thief E be.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141