Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Wetin Bubu And The Jagaban Dey Talk For Villa...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, May 04, 2022

Pidgin Post - Wetin Bubu And The Jagaban Dey Talk For Villa...

News carry am say President Bubu and the Jagaban,the Oga pata pata of political party APC meet on Tuesday for Aso Rock Villa and door close so nobody fit hint us wetin dem yarn....






Jagaban say e wan be President after Bubu sign out for May 2023 and na the matter we still dey look so because Party wey e form never give am the ticket to be dia presidential candidate....

 Bubu wey first talk some months back say e no go fit reveal person wey e want to take over from am but e don change mouth again talk say e no get any person for mind wey e want to take over....


Nah only wonder we fit wonder wetin dem talk 'behind closed doors'..

Maybe Jagaban go remind Bubu of how e take become President.... 

11 comments:

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141