Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Destiny Twerkers

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, January 13, 2023

Sisi Senaponi's Corner - Destiny Twerkers

Shuo!... Na wah oh!



Kpoi! Kpoi! Kpoi! Na who dey e?!
Stella-lush-de-la-posh! How de overs?!

This my customer wey get shop dey sell food, Na her second husband house she dey so!

The first one dey use punch redesign her face soteh, front teeth sef no complete again!
Na middle of night she pack her load run comot with her only son!

This second one wey she think say na better person as he dey gentle and he sef don divorce before, he come worse pass devil.
The woman begin look like times ten of her age! Her son wey she manage send go school do polytechnic, the boy dunce pass anything!

He slow pass slow motion. I say how he come manage graduate?

Na im person tell me say e be like say na anytime the boy no dey that house, him brain dey function. But once he enter that house, na remote mode he dey! *Udonminit!*

E nor too tey wey the husband former wife say make their son come begin follow the man and this new wife live.

The man son dey do well, even learn carpentry work!
Na im this my customer dey clean house one day, wey she see something inside her husband knicker!

Na the full name of her own pikin, plus her name and her mama name. She say na so she turn FBI begin search house, wey she see bottle with her pikin pisure inside with water dey smell like snail!

Nna ehn, i say wetin you do?!

She say she carry everything put for floor, wey she comot wrapper begin dey faya prayer!

I say so you sabi pray before wey your pikin battery dey hibernate!

Na her noise make neighbours call her husband say be like persin die o!
The husband rush come house, see everything as she naked! He go back him shop, he no talk anything!

For midnight, she begin another round of prayer for parlour!

She say husband still dey chop her food for house. Na same bed dem still dey sleep. She say the thing begin suprise her say he nor confess...
kiikiikii..God abeg o!

Na the man elder brother come her shop to tell her say na favour her husband do her o, Say dem tell the husband say the boy go quick get money but he no go live long.

So he decide to help and slow him down, make he no quick get money, so he no go quick kpai!

Na wa o! I say na who send him that kain work biko?!

She say she sef come begin wonder, say maybe na good thing her husband do because she nor fit born pikin again. *ololololoooo!*

9 comments:

  1. Replies
    1. I tell you no be small brain washing be this, the hubby and family just dey tell her white 🤍 lie, make she stop dey pray for their head. It's well God go help us..

      Delete
    2. Na to dey fire prayer steady, evil people

      Delete
  2. Things dey happen o,na who never jam wahala dey complain say e no get new cloth...... from fry pan to fire.

    ReplyDelete
  3. Sisi.. Dem dey whine day your friend oh. Why the husband go do that kind thing and he no tell the pikin mama? So now na him wan come love the son pass the mama? Make she break that bottle and set her son free from that bondage wey the man don put am.

    ReplyDelete
  4. Sisi use style tell your friend make she invite a good pastor make them pray break tht bottle o.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141